Monday, October 20, 2008

Madam and Housemaid

A housewife realizing that the housemaid had started behaving funny
decided to disengage her one morning.

Madam: "Chinyere why u dey behave anyhow these days? abi u dey craze
self? E be like say u no wan know ya mate for this house again o. U
carry craze for head? Abi face no dey fear face for ya village?"

Chinyere: "Look at you, which kind wife wey u be? Afterall my food dey
sweet pass ur own...."

Madam: "Ehn who told you u cook better than i do?"

Chinyere: "Oga now..."

Madam: "Lord have mercy. Papa Nkechi is coming to meet me in this
house... Na war between me and am today. Oooh no wonder... I dey
suspect since..."

Chinyere: "That's not all, I'm even better than u in bed..."

Madam: "Yeepa.. I'm finished. So... Who told u such thing?"

Chinyere: "The driver."

Madam: "Uhmm Chi baby, Chinyerry, Chinlosky...come here ehn... Good
girl.
Abeg no let Oga hear that one. OK...."

No comments: